Sports

Ghana coach defend why e drop Arsenal midfielder Thomas Partey for ‘do-or-die’ Afcon qualifiers

phot grid of thomas partey, jordan ayew and mohammed kudus

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

New Informate 5 minutes wey don pass

Underfire coach of di Black Stars Otto Addo don drop Arsenal midfielder Thomas Partey from di squad wey go play Ghana last two 2025 Afcon qualifiers games.

Di Arsenal midfielder wey be captain of di team miss di last round of games as di English club tok say make im no go international duty sake of wetin dey tok say na “physical concerns”.

But managers of di national team tok say dem neva dey convinced by di excuse as “di player no make imserf available for follow-up assessment” at dat time.

For dis round of matches wey be do-or-die for Ghana, di coach decide say im no go call Partey.

For one press conference on Thursday Otto Addo tok say “to play for di national team, you gat to be disciplined, you gat to be role model wey you gat to show performance.”

Di coach explain say if im see say players no dey show dis qualities, im dey tok to dem to improve but if dey neva change, im gat di right to drop dem.

“For me, na honour to play for di national team, no be about myself, wey I expect di same commitment from all di players.”

Otto Addo neva tok di exact reason why im decide to drop Partey but im tok say “I don explain to am why I no call am even though di midfielder tok me say im dey available to play.”

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

thomas partey

Wetin we call dis foto, Di Arsenal midfielder miss di last round of games as di Arsenal medical team tok say im get fitness issues

Jordan Ayew na new captain

In his absence, Leicester City striker Jordan Ayew go captain di team for di games vs Angola and Niger.

West Ham United star Mohammed Kudus wey captain di team for di last two matches – wey cause controversy for di kontri sake of oda senior players dey inside di team.

Dis time di coach say im decide to select new captain.

“I select new captain wey be Jordan, I bin tok to Kudus say make im understand say I want make im grow into di role and serve as di second captain togeda wit Alexander Djiku.”

“Jordan go take ova from now wey im go lead and guide di team,” di coach tok for di press conference.

Dis na di major changes for di team as dey prepares to face Angola on 15 November for Luanda bifor dey go play Niger three days later for Accra.

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

jordan in action

Wetin we call dis foto, Di Leicester city striker don make ova 100 appearances for di blackstars

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

team photo

Wetin we call dis foto, Ghana go fit qualify for di 2025 Afcon if dey win dia last two games and Sudan lose dia two games

Athletic Bilbao striker Inaki Williams and Bournemouth striker Antoine Semenyo dey among di squad wey fans go dey expect say make dey carry dia form for dia clubs to help di team.

Three home-based players – Isaac Afful (FC Samatex), Razak Simpson (Nations FC) and Emmanuel Antwi (Asante Kotoko) dey among di squad.

Some fans of di blackstars tink say hope still dey for di team to qualify for di Afcon wey go happun for Morocco, but odas tink say for di first time since 2004, Ghana fit to miss di tournament.

For di coach, di blackstars still get slim chance.

“E neva dey over. Mathematically, we still get chance wey we go do everitin in our power to keep dis chance alive.”

Otto Addo dey under pressure afta recent poor results, as some sabi pipo and fans already say make di Ghana football association sack am.

But di coach say im get confidence for im team to turn around di results.

Angola already qualify for di Afcon from group F wit 12 points from 4 games.

Sudan wey dia coach na former blackstars player and coach Kwesi Appiah dey second on di table wit 7 points.

Ghana dey third wit only 2 points as Niger dey bottom of di table wit one point.

Full 25-man squad

Dis na di 25- man squad for di upcoming games

Goalkeepers – Ati Zigi Lawrence, Manaf Nurudeen, Jojo Wollacot

Defenders – Alidu Seidu, Tariq Lamptey, Jonas Adjetey, Nathaniel Adjei, Alexander Djiku, Jerome Opoku, Gideon Mensah, Isaac Afful, Razak Simpson

Midfielders – Elisha Owusu, Abu Francis, Ibrahim Sulemana, Baidoo Michael, Mohammed Kudus, Emmanuel Antwi

Attackers – Ibrahim Osman, Ernest Nuamah, Antoine Semenyo, Jordan Ayew (c), Inaki Williams, Fatawu Issahaku, Joseph Paintsil

LEAVE A RESPONSE

Your email address will not be published. Required fields are marked *