Health

Nigeria goment wan do free c-section for women, how e go work?

Wia dis foto come from, Getty Images

Expectant mothers for hospital

Wetin we call dis foto, Pregnant women for health facility

Nigeria goment on Thursday announce free cesarean section (CS) for all women wey need am.

Di minister of Health and Social Welfare Prof Muhammad Ali Pate announce dis informate as e launch di Maternal Mortality Reduction Initiative for Abuja, di kontri capital on Thursday.

“No woman suppose die becos she no fit afford a C-section,” Pate tok.

Di minister say di aim of di initiative na to tackle Nigeria critical maternal and neonatal mortality rates – wey dey among di highest globally.

E say na Nigeria president Bola Tinubu get di initiative and dem plan to bring in about 120,000 additional health workers to support primary health care across Nigeria.

Who and who fit benefit?

Wia dis foto come from, Getty Images

pregnant woman

Wetin we call dis foto, pregnant woman

Senior Adviser Media and External Relations to di minister of Health Tashikalmah Hallah tell BBC say di initiative na for women wey need CS section and no fit afford am.

E add say di initiative no be for all cesarean sections, say na for only women wey dey emergency situation and no fit afford di cost.

Oga Hallah say na only goment accredited hospitals go fit offer dis service and na only di hospitals through dia social welfare units go fit determine say di expectant mother need CS section but no fit afford am.

E say di service dey ongoing already, through di National Health Insurance Authority NHIA.

“National Health Insurance Authority NHIA and di National Primary Health Care Development Agency (@NphcdaNG) plus State Health Insurance Agencies (SHIAs), go join hand manage di initiative,” e add.

World Health Organisation (WHO) say Nigeria get high mortality rate wey 1,047 deaths to 100,000 live deaths.

According to United Nations Children Fund (UNICEF), Nigeria get 40 million women of child bearing age (between 15 – 49 years) and plenti of dem dey suffer high level of health issues during childbirth.

About 172 local goment areas dey contribute to over 50% of maternal deaths presently for Nigeria, di data add.

Di kontri dey contribute 10 percent of global deaths for pregnant mothers.

Cost of CS section for hospitals dey at about 60,000 Naira ($36).

LEAVE A RESPONSE

Your email address will not be published. Required fields are marked *